Hey Ma II

If you don’t know what’s going on, read “Hey Ma” for further info, you may also read “Insights”. There’s pidgin below so be warned in case that’s not your thing.

****************************************************

 

Hey Ma I wrote you, you ain’t write back,

E don bad reach so? No be like dat,

Your son write you, you suppose reply sharp-sharp,

Meanwhile, where you been dey buy those rat traps?

 

E get some small tins wey you need to know:

We still dey wait maga – him never show,

I don make new songs but I never still blow,

And now you fit port your MTN carry Glo!

 

Your husband dey: hin never change much,

E still dey wait im bad son make e change much,

But you know say your son no dey gree fear God,

E still dey job Popsy upon say you don mud.

 

Johnny wife fit get belle but we no know,

Your granddaughter too fine – she don dey grow,

She resemble your Vivienne wey been don first go,

Speaking of Vivi, una don reunite so?

 

We don vex, we don crase, sotey we face turn blue,

We wan kill d driver wey make your bus tumble,

We still dey feel d pain, we still dey cry for you,

But we dey strong small small, abi how we for do?

 

We still dey miss your way, we still dey find your food,

Anytime we see your pix, we dey just turn confuse,

Yellow sisi, nobody fit fine pass you,

But Bible talk say “All things work together for good…”

 

The last letter wey I write na so so phon-eh,

So I say make I use pidgin wey u go hear,

Hey Ma, what’s it like? How’s it up there?

Mma Dan, reply na, dis tin is not fair o!

 

 

About cikk0

I think I'm proper sane. A lot of people seem to think different. Oh well... Locate a brother on twitter: https://twitter.com/#!/cikk0

Posted on May 3, 2013, in Poetry and tagged , , . Bookmark the permalink. 6 Comments.

  1. Awww… I laughed and cried. God keep you strong Chris

  2. Nna ehn. This peom tear my heart. Malle dey up dey laugh guy. Jisike n’obi oo! nna. Chukwu Gozie gi. Nwanne. It is well.

  3. She’s definitely happy n shit…well I’m not so sure of the shit part but she’s happy. 🙂
    Stay strong my man. My doors are always open for further FIFA thrashing.

  4. Bro,stay strong….times likes these need more of what U’ve got: strength. I’ve gat new recipes,U myt wannna try some. U know hw we do…lol

  5. I’m still not gonna let d tears drop. D lord is our strength in all tins.
    Beautiful post as usuall Cikk0 🙂

Leave a comment